Airport authority demand investigation, prosecution of Kwam 1 over airport drama wit ValueJet pilot Skip to main content

Airport authority demand investigation, prosecution of Kwam 1 over airport drama wit ValueJet pilot

  Di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don alert federal authorities make dem torchlight and prosecute popular Nigerian Fuji musician Wasiu Ayinde Marshall alias K1 De Ultimate. Dis dey come just hours afta di Aviation minister place K1 De Ultimate,70, for 'no fly list'. For di latest development, di NCAA petition di Attorney-General of di Federation (AGF), Lateef Fagbemi and di Inspector-General of Police (IGP), Kayode Egbetokun, make dem do full investigation into wetin happun between K1 De Ultimate and ValueJet officials for Abuja airport on Tuesday. NCAA say dia investigation find say di musician allegedly violate di Nigeria Civil Aviation regulations. Michael Achimugu, tok-tok pesin of di agency for statement tok say dem don order all airline operators make dem place K1 De Ultimate for no fly list make e no make any air travel, until di investigation don finish. Earlier, di Minister of Aviation and Aerospace Development of di Federal Republic of Nigeria Festus Keyamo...

Airport authority demand investigation, prosecution of Kwam 1 over airport drama wit ValueJet pilot

 

Di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don alert federal authorities make dem torchlight and prosecute popular Nigerian Fuji musician Wasiu Ayinde Marshall alias K1 De Ultimate.

Dis dey come just hours afta di Aviation minister place K1 De Ultimate,70, for 'no fly list'.

For di latest development, di NCAA petition di Attorney-General of di Federation (AGF), Lateef Fagbemi and di Inspector-General of Police (IGP), Kayode Egbetokun, make dem do full investigation into wetin happun between K1 De Ultimate and ValueJet officials for Abuja airport on Tuesday.

NCAA say dia investigation find say di musician allegedly violate di Nigeria Civil Aviation regulations.

Michael Achimugu, tok-tok pesin of di agency for statement tok say dem don order all airline operators make dem place K1 De Ultimate for no fly list make e no make any air travel, until di investigation don finish.

Earlier, di Minister of Aviation and Aerospace Development of di Federal Republic of Nigeria Festus Keyamo say e receive di reports of di incident and e say both K1 De Ultimate and di pilot act under "case of temporary loss of sanity and control on both sides wey fit don lead to serious fatalities."

"For dis circumstance, I don direct make di NCAA place KWAM 1 for NO-FLY list pending further and full investigation, just like di Captain and Pilot."

"All airlines both domestic and International make dem immediately dey informed of dis directive and anyone wey go against dis directive risk withdrawal of dia operating licence."




Authorities commence investigation, release video

Popular Nigerian Fuji musician Wasiu Ayinde Marshall wey pipo sabi well-well as K1 de Ultimate don react to di tori wey dey spread on top one incident wey happun on Tuesday, 5 August for Nnamdi Azikwe International Airport, Abuja, di country capital between imsef and one ValueJet airline pilot.

On Wednesday, 6 August, one video begin go viral on social media wey show K1 for di front of one plane while airport officials dey follow am tok.

Di pilot, however, take off, and di musician and di airport officials wey stand close to di plane bin dodge as di plane dey taxi.

Dis incident don lead to plenty reactions on social media, e also don lead to di suspension of two ValueJet pilots.

Di aviation bodies Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) and di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) wey say dem dey carry out full investigation on top di incident don submit different preliminary reports.

Meanwhile, di Fuji singer K1 wey be influential musician for Nigeria say di tori wey dey spread say im try disrupt airport security operations plus say im carry alcohol to board plane na fake tori.

According to one statement, wey im media aide Kunle Rasheed issue and wey K1 post on im verified account, e say, "e no get any point wey K1 take act for manner wey endanger lives or breach safety regulations. Di substance in question — wey dey wrongly sensationalized — no pass plain drinking water, wey dem give am for airport lounge as e dey wait to board di aircraft."

Di statement add say "claims say K1 block di aircraft or attempt to disrupt operations na false."

FAAN release preliminary investigation, launch further probe

On Wednesday, 6 August, di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) bin release one preliminary investigation on di incident.

For di statement wey dem release, dem confam say K1 bin dey scheduled to board di flight, but during boarding, e bin attempt to carry one unidentified liquid on board, despite repeated warnings from Aviation Security (AVSEC) personnel and di Flight Captain

"In accordance wit international aviation security standards specifically, Nigeria National Civil Aviation Security Programme (NCASP) and ICAO Annex 17-liquids wey pass 100ml no dey permitted through security screening unless medically necessary and properly declared. Dem inform di passenger of dis regulation but e reportedly decline to comply.

"As boarding continue, one airline security officer ask di passenger to step aside for further clarification. Di passenger allegedly no gree and e pour di contents of di flask on di officer, wey turn out to be alcohol. Di Flight Captain intervene but face similar resistance. Afta she confam say di boarding dey complete, she instruct di closure of di aircraft door." FAAN tok-tok pesin Obiageli Orah write for statement.

Di statement add say, di passenger later move go di front of di aircraft and no gree leave di area despite repeated requests say make e comot. Na AVSEC crime unit later escort am away for further investigation, afta dem release am.

FAAN say di mata still dey under thorough investigation, and all parties wey get hand for di mata go dey accountable according to di law.

NCAA on top di incident say dem don suspend di licences of Captain Oluranti Ogoyi, plus dat of di co- pilot, First officer Ivan Oloba wit immediate effect.

"Dis suspension go remain in place pending di conclusion of a full investigation into di incident," NCAA tok for statement.

NCAA say dem bin receive reports on top di serious breach of aviation safety protocols by a ValueJet pilot for di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja (Domestic Terminal) on Tuesday, August 5, 2025.

According to di statement wey dia tok-tok pesin Michael Achimugu issue on Tuesday, 5 August, e say preliminary information indicate say di pilot in question bin commence departure procedures from di designated bay without adhering to di mandatory pre-departure clearance protocols.

E add say dis reckless action bin endanger di safety of ground personnel plus oda airport users, and e go against established civil aviation regulations and international safety standards.

We dey cooperate wit di NCAA for dia investigation - ValueJet

Di management of ValueJet airline for dia response say dem don remove di crew wey dey involved for di incident immediately from active duty, pending di outcome of a thorough internal review and investigation wey don start to understand di root cause and to prevent any recurrence.

Di airline for statement also say dem dey cooperate wit di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) for dia ongoing investigation.

Comments

Popular posts from this blog

A Nigeran Lady Zanaib went to Nigera to stabs her Ex-Husband Because of DNA

 A Prostitute  Zainab ran away from Libya to Germany because her ex-partner Zaccehus asked for his 2 children's DNA she had for him in 2010- 2012 in Libya. Zainab gave his 2 children to another man and was stabbed with a knife by Zanaib on the 15th of June 2024 when Zanaib traveled from Germany to Nigeria and confronted her ex-partner Zaccheus for persistently calling her husband Ade in Germany to return his 2 children she abducted to Germany.  If you know where she resides in Germany, please inform the Ijebu Police station.

Teenager commits suicide on livestream and his mother walked in on the heartbreaking scene (video)

A mother has been left devastated after her son committed suicide on  livestream  and she walked in to see his dead body. The 18-year-old Canadian teenager filmed his suicide for his followers to watch. He had a bandana covering his nose and mouth as he got ready to take his life. He had written a suicide note and he slid it out of the room, together with the key to the room he was in, through the space beneath the door. When he was done with this, he put a gun to his head and killed himself.

Who is Esabod?

The name Esabod is a household name. The name came from the names of Madam Esther Tokunbo Aboderin. She was born in Ibadan in the year 1961 March 26th. Her mother was late madam Foyeke. She was born into the famous Aboderin family of the ancient city of Ibadan. She started secondary school in the year 1974 and graduated in 1979. She was admitted into the University of Ibadan to study Medicine,l.she did not finish the study and left the school to work at the default toll gate in Ibadan.