Di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don alert federal authorities make dem torchlight and prosecute popular Nigerian Fuji musician Wasiu Ayinde Marshall alias K1 De Ultimate. Dis dey come just hours afta di Aviation minister place K1 De Ultimate,70, for 'no fly list'. For di latest development, di NCAA petition di Attorney-General of di Federation (AGF), Lateef Fagbemi and di Inspector-General of Police (IGP), Kayode Egbetokun, make dem do full investigation into wetin happun between K1 De Ultimate and ValueJet officials for Abuja airport on Tuesday. NCAA say dia investigation find say di musician allegedly violate di Nigeria Civil Aviation regulations. Michael Achimugu, tok-tok pesin of di agency for statement tok say dem don order all airline operators make dem place K1 De Ultimate for no fly list make e no make any air travel, until di investigation don finish. Earlier, di Minister of Aviation and Aerospace Development of di Federal Republic of Nigeria Festus Keyamo...

All I can say is tank you lordI am grateful for gracing my life with additional year glory be to your holy name hapi birthday to me
Comments
Post a Comment